Nigerian Army deny Lekki toll gate Lagos shooting, say Sanwo-Olu goment call dem into #EndSARS protest

Nigerian Army deny Lekki toll gate Lagos shooting

Nigerian Army don deny Lekki toll gate shooting on Tuesday 20 October, 2020, say na Govnor Babadije Sanwo-Olu goment goment of Lagos State call dem into #EndSARS protest

Inside statement from Nigerian Army 81 Division headquarters wey BBC Pidgin cari eye see, di army say:

"Di attention of Headquarters 81 Division Nigerian Army (Victoria Island Lagos) don see one video wey don spread full everiwia alias viral on social media wey show say civilian protesters suffer massacre by sojas for Lekki Toll Plaza. Dis allegation no be true, e dey aimed at causing anarchy inside di kontri.

"However, di decision to call in di military to end di katakata alias violence wey happun on dat fateful Tuesday na Lagos State Government (LASG) decide dat one afta dem declare 24- hour curfew." Di statement add.

Di army statement dey come exactly seven days afta some states for di kontri record violence and looting of public and private business afta di Lekki toll gate incident for Lagos wia army shoot unarmed #EndSARS protesters.

Na Major Osoba Olaniyi, di tok tok pesin of Nigeria Army 81 Division issue di statement.

Nigerian Army on "Lekki Toll Gate Nigeria"

Wia dis foto come from, Screenshot

Nigerian Army on "Lekki Toll Gate Nigeria"

Wia dis foto come from, Screenshot

Nigerian Army on "Lekki Toll Gate Nigeria"

Wia dis foto come from, Screenshot

Nigerian Army on "Lekki Toll Gate Nigeria"

Wia dis foto come from, Screenshot

Wetin we call dis foto,

Na Major Osoba Olaniyi, di tok tok pesin of Nigeria Army 81 Division issue di statement.

Wetin really happun on dat 'Black Tuesday' for Lekki Toll Gate?

Armed soldiers fire live bullets and fire works at thousands of #EndSARS protesters gada for Lekki toll gate inside Lagos, Nigeria.

Tori be say Nigerians no look goment face still continue di #EndSARS protests for Lagos even afta di 24 hour curfew wey goment declare to start from 4pm on Tuesday.

Kasala start wen thousands of protesters wey full Lekki toll gate still dey protest begin hear gun shots for air.

Di next tin everiwia scata and become rowdy. E no dey clear how many wunjure wen e happun around 6:45pm Nigerian time.

Di next tin wey happun na say di sojas don form wall alias barrier gada round di protesters wey no gree run.

Di protesters tanda for ground insists say dem go continue di protest against police brutality.

Gist be say Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu don order say make di enforcement of di 24hour curfew no start until 9pm to enable pipo wey hook for traffic to get to dia domot.

Nigerian Army deny Lekki toll gate Lagos shooting

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin don happun afta di Lekki Toll Gate shooting?

In fact di morning afta di shooting di govnor blame wetin im call "forces beyond im direct control" for Tuesday night shooting of #EndSARS protesters.

Na afta Govnor Sanwo-Olu visit hospitals wia dem rush victims dia Lagos goment say at least 30 pipo wunjure for di Lekki toll gate protest on Tuesday.

Rights group Amnesty International say investigation wey dem do show say at least 12 na im die for two locations on Tuesday in Lagos.

Amnesty International say di Nigerian army and police kill at least 12 peaceful #EndSARS protesters on Tuesday for two locations in Lagos wey be Nigeria commercial city.

Di killings take place for Lekki and Alausa, where thousands of pipo bin dey protest police brutality as part of the #EndSars movement.

Just before di Army come out deny, di Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu on Monday 26 October 2020 admit during one CNN interview say from di video wey dem see, because cameras dey di toll gate, e be like na men in military uniform wey fit be Nigeria army carry out di shooting.

Di Lagos goment don set up panel on inquiry to begin hear evidence wey dey related wit di incident.

Lekki Toll Gate Lagos Nigeria

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto,

Dis panel hearing dey come as some states for Nigeria record violence and looting of public and private business afta di Lekki toll gate incident for Lagos wia army shoot unarmed #EndSARS protesters.

Governor Sanwo-Olu say di CCTV footage from di toll gate go dey part of di investigation wey Lagos state don already begin on Monday, e go dey available for di judicial panel to review.

Army pipo wey dey armed true true kill #EndSARS protesters for Lekki toll gate shooting for Lagos, Nigeria House of Representatives Speaker Femi Gbajabiamila wey be Lagos federal lawmaker comfam.

"E dey unavoidably and painfully clear say get a number of casualties as a result of gunfire for Lekki Toll Gate, Lagos Nigeria."

Na so Oga Gbajabiamila react as e confirm deaths wey happun fron Tuesday #EndSARS protests wia armed sojas fire live bullets at unarmed protesters.

So na who order di Lekki Toll Gate shooting? Nigerians dey ask!